Ministry of Enjoyment (Part 5)
- April 03, 2018
- by
Shey we, whey no see food chop,
Na hin we wan afford education?
He be like say na only the rich get education?
Na only the rich get the country sef.
You don pass sote for road
We dey pack sand pour for the hole
Whey you create with your ayókélé
Road whey be say na your constituency project
My oga at the top, we dey hail you
You no fit put hand for pocket
Give we dem boys something
Upon all the eulogy whey we give you
We don tire to dey suffer
Nothing to show for the vote whey we dey supply
You sha no know wetin we dey pass through
We don tire to dey look too.
© Abiola Justice David
0 comments:
Post a Comment