Ministry of Enjoyment (Part 3)
- April 03, 2018
- by
My Oga at the top
Na una I come greet
I salute una well well
For all the tins whey u dey do
We whey no see food chop
Na sote worms and crumbs we dey chop
The crumbs self whey no regular,
Some animals don dey share am with us.
Suffer and suffer head dey the land sote
Education expensive, job no dey
Resouces dey, but no gree circulate
Amenities, na 0 X 100=...
Education whey be say na free before,
The thing com turn góòlì now
When the tin no scarce self,
Where the employment dey?
© Abiola Justice David
0 comments:
Post a Comment